This is a good news for some people at disame time is a bad news too. But Our Almight God know all things. For those that were choosen before, just have the believe that, this year is your year.
yesooo, my guy last last e don be for me, no be God? how ur plans?
Yeah but this hurts so much and especially We regret any inconvenience this might have caused. It sounds like a Nigerian thing which you always expect and everything sounds unamerican, undeveloped and childish.Am so messed up!
Ozah, so u don land yankee, and u forget to carry me along. What about the Ghana must go bag we both agreed. U and Heavenborn are planning to live me in Naija abi. God dey see una oooo. Well, i'm happy 4 u. How dat zone be now. Bros, give me load down. I heard DV 2012 had been cancelled. I really feel for those guyz who were won initially and i pray they still come out successfully. Well, as for me, i'm going back to my praying room. God must answer my prayer this time. Congrat to u once again and may the favour of God rest upon u. One love bro!
Yeah but this hurts so much and especially We regret any inconvenience this might have caused. It sounds like a Nigerian thing which you always expect and everything sounds unamerican, undeveloped and childish.Am so messed up!
kennyeast,good to know you arrived chicago safely,but it was a long flight,is there no other alternatives,because i am travelling with 3kids.
yesooo, my guy last last e don be for me, no be God? how ur plans?
lolll, Oza, how far, i no forget u o, i only pray say make God change rules for ur sake, this one wey u come dey talk say u feel bad say them cancel the result so, i go need change my prayer,loll.... o boy yankee dey fine o, cold want finish me sha, i stay in the south in chicago, very close to the lake so the cold 4 there na die. anywhere i feel 4 those who av won already and pray that this time around it favor more of u guys. Good luck.
Bros, abeg no change ur prayer for me ooo. I just dey feel for those guyz who lost it, cos if na me, i go cry die. Well, everything work together for good to them dat love God. If u dey feel cold, make u dey drink hot water or make u dey bath hot water. U no well, the time wey u dey play lottery to AMERICA, u no no say na cold country u dey go? Make i no hear dat from ur mouth again. Infact make snow dey fall for ur roof sef IJN AMEN. I trust my God for a miracle this time. I will join u someday whether good or bad. All the best bro! My baby boy is growing everyday and i will give him a better life than mine. One love!
Olorogun kennysouth...unto southside Chi-city... oboy na God! meanwhile ur boy dey o! the plans is still on. Kenny did u evaluate ur credentials with WES? I need info on how to go about dat.